
Remember,
O Virgin Mary wey full of grace well-well,
say dem never hear
say anybody wey run come under your protection,
beg you make you help am,
or ask you make you pray for am
no receive help.
With the courage wey this trust give me,
I run come meet you,
O Virgin wey pass all virgins, my mama;
na you I come meet,
na for your front I stand,
as sinner wey dey full of sorrow.
O Mama of the Word wey become human being,
no look down on my prayers,
but for your mercy,
hear me and answer me.