O Lord our God, na only You be di King wey holy pass all and di Ruler of all nations.
We dey pray to You, Lord, with strong hope say we go receive mercy, peace, justice and all good things from You, O Divine King.
O Lord our King, protect our families and di land where dem born us.
We dey beg You, You wey faithful pass all, guard us.
Protect us from our enemies and from Your just Judgment.
O King wey get supreme authority, forgive us for di sins wey we don commit against You.
Jesus, You be King of Mercy.
We don deserve Your just Judgment
Lord, have mercy on us and forgive us.
We trust in Your Great Mercy.
O King wey Your majesty dey fill us with awe pass all, we bow before You and pray;
Make people for earth recognize Your rule, Your Kingdom.
Amen.