Papa, I dey dedicate this new day to You;
as I dey do my work.
I dey ask You to bless everybody wey I meet.
Lord, I dey pray for all men and women
wey dey work to get wetin dem go take live;
make dem find satisfaction for wetin dem dey do.
Spirit of God,
comfort people wey no get work and their families;
dem be Your children and my brothers and sisters.
I dey ask You to help dem find work soon.
Amen.
Na St. Ignatius Loyola write am