Nigerian Pidgin

How Jesus Cleanse di Temple

Oda Wey Dem Go Follow for Holy Hour

Baibul Reading: John 2:13–25

Di Background: After you don read di Scripture wey dey above at least once, read di points wey follow. Dem give short teaching wey still get details about how Jesus Cleanse di Temple:

  • Di Feast of Passover na di most important feast every year. All di men must appear before di Lord. Plenty of dem do this by going on pilgrimage to di Temple to offer sacrifice to God.
  • People wey get money offer sheep or oxen. Poor people offer nduru or pijon. 
  • Because of di Feast, people full di Temple well-well. Plenty of dem dey try make money from di religious duty wey people get to appear before di Lord and offer sacrifice.
  • Saint Ignatius point out say Jesus use plenty strength and force drive di money changers and people wey dey sell big animals comot from di Temple, but na only strong advice He give people wey dey sell nduru and pijon, make dem carry di birds comot from di Temple.
  • Jesus show say He and di Temple get close connection, as He call am His “Papa house.”
  • When di Jews ask for sign wey go show say Jesus get authority to drive everybody comot, He talk say if dem destroy di Temple, He go build am again in three days. This na prophecy about how Jesus go rise from di dead three days after dem kill Am.
  • Jesus also make am clear say di true “Temple” na His own body. Na Him be di new Temple wey di fullness of God dey live inside.
  • We fit also understand di Temple as our souls, since God dey live inside us. We become di temple of God. One of di missions of Jesus na to use zeal drive every sin comot from our souls.

Reflection: Read the tori for Scripture once again, then begin to think deep with prayer about these things:

  • Think deep about how di Feast dey come near. Imagine di months and weeks before am. Imagine di planning and how everybody dey look forward to am. Think about everybody wey dey involved during di months before this encounter: money changers, sellers, rich people, poor people, all di pilgrims, and Jesus and His disciples.
  • Imagine di commotion for di Temple area wey people full pass, di smell of animals, di noise, di greed, di blood of animals inside di Temple, di dry heat, and other things like that.
  • Imagine as Jesus reach di Temple. Think deep about di righteous anger wey rise inside Am as He see how dem dey make His Papa house unholy.
  • Think deep about di whip wey dem make with cords, how Jesus dey drive di animals comot, turn di tables upside down, and other things like that.
  • Now turn your mind to di temple of your soul. Na also di Papa house. You be holy place wey God dey live.
  • See also di sin and dirt wey you don allow enter your soul. As you dey do this, see Jesus as He dey see this sin and dey seek to drive am comot with great zeal. How you respond? Na with gratitude? Or you dey resist Am?

Main Image:Christ Dey Cleanse di Temple, by El Greco

Introduction to Meditations for Ordinary Time

  1. Baptism of di Lord
  2. Di Two Flag
  3. Three Group of People
  4. Temptation
  5. How Jesus Call di Apostles
  6. Wedding for Cana
  7. How Jesus Cleanse di Temple
  8. Di Sermon for di Mountain
  9. To Calm di Storm
  10. To Walk on Top Water
  11. Dem Send di Apostles to Preach
  12. How Mary Magdalene Turn to God
  13. How Christ Feed di Five Thousand
  14. How Christ Appearance Change
  15. How Lazarus Rise from Death
  16. Evening Meal for Bethany
  17. Three Way to Dey Humble

List of Wetin Dey Inside

Share Dis Page: