Nigerian Pidgin

Page for Details

Buku Dem for My Catholic Life!

Volume Wan: My Faith as Catholic!

Volume Tu: My Worship as Catholic!

Volume Tri: My Moral Life as Catholic!

Copyright © 2019 na of My Catholic Life! Inc. Di third revision. Dem reserve all rights. See www.mycatholic.life/copyright-permission for more information about how to copy am to use.

For this third revision, small-small things for di way dem arrange di text different from di earlier versions.  Dem no change wetin dey inside. Di way dem number di pages change small.

Parts wey dem take from di English translation of di Catechism of di Catholic Church for use for United States of America Copyright © 1994, United States Catholic Conference, Inc.—Libreria Editrice Vaticana.  Dem use am with permission.

All references from di Catechism of di Catholic Church dey appear as Catechism or CCC.

Di Scripture texts for this work come from di New American Bible, revised edition © 2010, 1991, 1986, 1970 Confraternity of Christian Doctrine, Washington, D.C., and dem use dem with permission from di copyright owner. Dem reserve all rights. Nobody fit reproduce any part of di New American Bible in any form unless di copyright owner give permission for writing.

Na Ritman University Press, 104 B Umuahia Road, Ikot Ekpene, Akwa Ibom State, Nigeria, first print di third revision. 

Imprimatur:
Most Reverend Camillus Raymond Umoh
Catholic Bishop of Ikot Ekpene Diocese
1 December, 2019
First Sunday of Advent, Year A

Nihil Obstat:
Rt. Rev. Msgr. J. F. Iyire
Vicar General
Ikot Ekpene Diocese


Dedikeshon

To our Blessed Mother.  Di way she dey care for us as our mother, di way she surrender herself completely to wetin God want, and her powerful intercession na gifts wey nobody fit measure.  Make her heart shine through these pages, and make everybody wey read dem share for her faith.


Na Who Write Am

 John Paul Thomas

“John Paul Thomas” na di name wey this author choose to dey use write, to honour di Apostles Saint John and Saint Thomas, and di great evangelist Saint Paul.  This name still dey remind us of di great Pope Saint John Paul II.

John na di beloved Apostle wey seek deep, personal and close relationship with im Saviour.  We hope say di writings for dis book go lead all of us to deep, personal and close relationship with our God.  Make John be example of dis closeness and love for us.

Thomas too na Apostle wey dem love well-well and close friend of Jesus, but people know am well because e no believe say Jesus don rise from death.  Even though e later enter deep faith and cry out, “my Lord and my God,” dem give us Thomas as example wey show how our own faith dey weak.  Make Thomas encourage us to always return to faith whenever we realise say we don doubt.

As Pharisee, Paul persecute di early Christian Church well-well.  But after e experience powerful conversion, e later become di great evangelist to di Gentiles, start plenty new communities of believers, and write plenty letters wey dey inside Sacred Scripture.  Im letters dey come from deep inside im heart and dey show di heart of shepherd.  Paul na example for all of us as we dey try accept our calling to spread di Gospel.


Buku Dem for My Catholic Life!

Introduction to these three buku wey form one series

Di Buku Dem for My Catholic Life! na three buku wey dem write as complete summary of our glorious Catholic faith!  Di aim of these buku na to answer di hard and deep questions about life in clear way wey people fit understand.  We need to know who we be and wetin life really mean.  We need to know who God be and wetin E don tell us through di ages. 

Di First Buku, My Catholic Faith!, na summary of di Apostles’ Creed and di Nicene Creed.  This buku dey look at everything from how God create di world reach God plan for salvation wey go last forever.  Other topics include: life after death, di Trinity, saints, our Blessed Mother, faith, and di Church.  Na summary of di teaching for di Catechism of di Catholic Church #1–1065. 

Di Second Buku, My Catholic Worship!, na summary of di life of grace wey dey for prayer and di Sacraments.  Plenty times, people fit see di Sacraments as dry rituals wey nothing dey inside.  But for true, na dem be di greatest treasures wey we get!  Na God wey truly dey present among us!  This buku na summary of di Catechism of di Catholic Church #1066–1690 and #2558–2865.

Di Third Buku, My Catholic Morals!, na summary of Catholic teaching about right and wrong conduct.  E dey show di principles of right and wrong conduct for our faith, and e still give summary of all our Church teachings about how we suppose live.  Na summary of di Catechism of di Catholic Church #1691–2557.

Share Dis Page: