
O God we hide from eye, with devotion I dey adore You, You we truly dey under di forms we dey my front; I bend my knee and bow my heart to You, because my mind no fit fully understand You as I dey contemplate You.
Jesus, Shepherd forever! Hear our cry; increase di faith of all di people we their souls rely on You.
Eye, touch and taste dey deceive person about You; na only wetin ear hear person fit trust with full assurance: I believe everything we God Son don talk; no sign of truth sure pass di word of Truth imself.
For cross, na only Your Divinity hide from eye; but here, Your humanity hide too; and as I profess my faith in both, I dey pray di same prayer as di thief we repent.
I no see Your wounds as Thomas see dem; still, I profess say na You be my Lord and my God; make my faith in You dey grow more and more; make my hope and my love dey rest in You.
O You we be memorial of our Lord own death! O living bread we dey give life to people we go die! Make my soul live on You from now, and always give am taste of heavenly sweetness.
O Pelican we full of love! O Jesus our Lord! I no clean, but wash me clean with Your Blood! Just one drop of am, we pour out for sinners, fit wash di whole world clean from all im guilt.
Jesus, we I dey see now under veil, abeg, grant me wetin I dey thirst for so much: make I see Your face without any veil, and make I receive di blessing of seeing Your glory.
Amen.
Na St. Thomas Aquinas write am