Make you and your children pray am before dem go sleep or before Sunday Mass

My Lord Jesus wey be small pikin, I love You and I thank You for this Advent season. Abeg, help me make I understand everything wey You don do for me. Your mama wey love You carry You for her heart and bring You enter this world. Help me make I do the same.
My Jesus wey love me, for this Advent, I choose You as my King and my God. Draw me near You and help me make I see my sins, so that I fit change the things wey You want make I change.
Mama Mary, pray for me for this Advent so that I fit do everything wey God want make I do. You talk “Yes” to everything wey God ask you to do. Abeg, pray for me make I fit do the same.
Come, Lord Jesus,
Come, Lord Jesus,
Come, Lord Jesus, come!
I love You, Jesus.
Amen.